Dem say na Peter Obi fit do am because say e no dey corrupt
Dem say na Tinubu fit do am because say e get the knowledgeย
Dem say na Atiku fit do am because say e get the experienceย
ย
E don tire Nigerians, dem want messiah wey go change everythingย
Dem believe say the country go good if their candidate enter
Na so so hope dem dey get
ย
Na play dem dey play, the government and the people dey play
How one man wan take save 200 million people?
No be play be that?
ย
Dem dey find change when dem no even know wetin change dey aboutย
Dem want change but dem no wan gree change
Dem dey play
ย
Dem talk say politicians corrupt, na soso swear dem dey give themย
But who elect the politicians wey corrupt?
Shey the people sef no corrupt?
ย
If rain fall, danfo go double the money e dey collect from peopleย
If dollar rise small, even ponmo woman go add money for her market
Everybody be scammer
ย
Boss dey misuse power for office
Lecturer dey misuse power for universityย
Pastor dey misuse power for church
ย
Election dey come and everything dey worseย
Government dey make policy
Citizens dey make their own policyย
ย
Naira turn gold, e don get black marketย
Fuel don turn diamond, na person wey get money dey buy am
Light don enter prayer point, na to dey pray say make dem bring am
ย
The government no do well
The people sef no do well
Na everybody corruptย
ย
We dey find change when we sef no be better person
You no fit help your neighbourย
You dey add plenty money for your market because say you get the power
ย
If una like make Obi, Tinubu, or Atiku enterย
Nigeria go still dey jagajaga if we no changeย
Messiah no dey come, na we be the Messiah.
ย
ย
ยฉย Judah Kolawole, 2023
Content Writer, Public Relations Specialist.
ย


















